Гуру Песен Популярное
А Б В Г Д Е Ж З И К Л М Н О П Р С Т У Ф Х Ц Ч Ш Э Ю Я
# A B C D E F G H I J K L M N O P Q R S T U V W X Y Z

Fela Kuti - Power Show | Текст песни

POWER SHOW

I open my eye I see for my land
*(CHORUS) NA WRONG SHOW O
Everywhere you dey
Everywhere you go
Everybody want do power show
*(CHORUS) NA WRONG SHOW O
You reach boarder immigration
officer dey immigration

Him go bluff you
*(CHORUS) YES – [AFTER EACH LINE]
Waste your time
Change him pen him pants
Some dey comb dem hair
Den tidy dem table
Den him/dem pull dem chair

Before him go know say you dey there
If you no talk quick
Him go go for shit
Him go shit come-back
And you talk to am
Then you suprise when him
Shack for you
Him go say you no go cross
You no go cross today
Na that time dem go start
Dem Power Show O O
Na wrong show
Go post office na the same
Dem go bluff you
Waste your time
Run you up
And then run you down
Dem go tire your body
And then tire your mind
And them tire your whole mind
Dem go say no change for fifty kobo
Na that time dem go start them

Power Show O O
Na wrong show O
Motor car owner sef him go take
him car push him car push laborer
Down for road
Then him start to yab* (tease/bother)
Foolish labourer
Nonentity, him no get money
Look him sandals e don tear finish
Look him trouser e don tear for yansh** **(ass)
Look him singlet e don dirty finish
Look him body e no bath this morning
Look him pocket e don dry finish
You go suffer for nothing
You go suffer for nothing
You no know me sha?
I be General for Army Office I
I be Officer for Police Station
I be secretary for government office
You foolish laborer, you go suffer for nothing
Nonentity, you go suffer
for nothing
Na that time dem go start dem

Power Show
Na wrong show O
Power Show na wrong thing
*(CHORUS) YES

Na sad thing
Na sad thing
Na wrong show O
Power na to help your land
Na to help your mates
Na wrong show O

Статистика страницы на pesni.guru ▼
Просмотров сегодня: 1
Видео
  • Fela Kuti - Power Show Fela Kuti - Power Show
    Fela #Kuti - Power Show Na sad thing Na bad thing Na wrong show O ... Fela Kuti ...
  • Fela Kuti - Power show! Fela Kuti - Power show!
    "Power Show (Edit)" by Fela Kuti & Egypt 80 (Google Play ... of Nigeria and the power show ...
  • power show,fela kuti power show,fela kuti
    Fela Kuti, kept it African in the most African way in an African method with an obstinacy, an ...
  • FELA ANIKULAPO KUTI= Powershow ==LIVE IN ... FELA ANIKULAPO KUTI= Powershow ==LIVE IN ...
    FELA ANIKULAPO KUTI===LIVE IN BERLIN 1970S.
  • Fela Anikulapo Kuti - Powershow Fela Anikulapo Kuti - Powershow
    Brilliant music by Nigeria's finest taken from the Egypt 80 album Original Suffer Head. Truly ...