All the wahala**, all the problems, **(affliction/trouble) All the things, all the things they go do, For this world go start, When the teacher, schoolboy & schoolgirl jam** together **(meet)
Who be teacher? I go let you know... (repeat 3x)
When we be pikin**, **[child] *[CHORUS] ‘FATHA/ MAMA” BE TEACHER When we dey for school *[CHORUS] TEACHER BE TEACHER When we dey University *[CHORUS] LECTURER BE TEACHER When we start to work *[CHORUS] GOVERNMENT BE TEACHER Who be government teacher? *[CHORUS] CU-ULTURE AND TRADITION Who be government teacher? *[CHORUS] CU-ULTURE AND TRADITION Cu-ulture and tradition *[CHORUS] CU-ULTURE AND TRADITION Cu-ulture and tradition *[CHORUS] CU-ULTURE AND TRADITION
Now the problem side, of a teaching student-ee I go sing about I don pass pikin, I don pass school, university, se-fa pass As I don start to work, na government I must se-fa pass Da go for France
*[CHORUS] YES SIR (*after each line) [occassionally “YES MAAM”] Engi-land Italy Germany Na dem culture For der’ Be teacher For dem Go China Russia Korea Viet Nam Na dem culture For der’ Be teacher For dem Go Syria Jordan Iran Iraq Na dem culture For der’ Be teacher For dem
Let us face ourselves for Afrika Na de matter of Afrika This part-ee of my song Na all the problems of this world In we dey carry, for Afrika
Wey no go ask-ee me *[CHORUS] WHICH ONE? (repeat 4x)
Problems of inflation *[CHORUS] WHICH ONE? (after each line) Problems of corruption Of mismanagement Stealing by government Nothing dey we carry All over Afrika Na de latest one Na him dey make me laugh
Austeri- *[CHORUS] AUSTERITY *(after each line) *(belt tightening/rationing) Austeri- Na him dey latest one Na him dey make me laugh Why I dey laugh? Man no fit cry?
Who be our teacher na Oyinbo? Who be our teacher na Oyinbo? A na false, the first election And the second election held in Nigeria Na the second election na it was na pass Boba la nonsense
*[CHORUS] BOBA** LA NONSENSE (*repeat after each line) **(misinform,) Boba la nonsense He pass o regime-o He pass corruption Which kind election be dis? People na go vote Dem come get big big numbers Thousands to thousands Millions to billions Which kind election be dis? Boba la nonsense
Na dem-o-cr-azy be the deal-oh Na dem-o-cr-azy be the deal-oh Who don teach us ee dem-o-cr-azy? (bo-ptch) Oyinbo** teach-ee us **(foreigner/white) (yuh-ngh) Oyinbo for Europe -oh Oyinbo teach us many many things-ee Many of dem things I don sing about-ee Me I no gin copy Oyinbo style Let us think say, Oyinbo no pass me When Shagari finish him elections Wey dem no tell am, say him make mistake Say this yo, no be democracy Oyinbo dem no tell army self Na for England-ee, I me no fit take over I come think about this demo-crazy
Democrazy *[CHORUS] DEMO-CRAZY (*after each line) Crazy demo Demonstration of craze Crazy demonstration If it no be craze Why for Afrika? As time dey go Things just dey bad They bad more and more Poor man dey cry Rich man dey mess Demo-crazy Crazy demo Demonstration of craze Crazy demonstration
If good-u teacher teach-ee something And he student make mistake Teacher must talk-ee so But Oyinbo no talk-ee so I suffer dem, Dey suffer dem Dem dey say dey teaching get meaning Different different meaning Different different kinds of meaning That is why I say That is the reason of my song