E be say you be colonial man You don be slave from before Dem don release you now but you never release yourself
Colomentality
E be so , E be so dem dey do, dem dey overdo all the things wey dem dey do e be so dem dey do, dem think say dem better pass dem brother. No be so?
E be so
The thing wey black no good na foreign things dem dey like. No be so? *[CHORUS] EE BE SO/ I BE SO Dem go turn air condition and close dem country away. Na be so? E be so Dem judge him go put white wig and jail him brothers away No be so? E be so
Dem go proud of dem name and put dem slave name for head No be so? E be so
Colomentality now make you hear me now
*[CHORUS] COLO MENTALITY
Mr. Ransome you make you hear Mr. Williams you make you hear Mr. Ali -a you make you hear Mr. Mohammed you make you hear Mr. Anglican you make you hear Mr. Bishop you make you hear Mr. Catholic you make you hear Mr. Musulim you make you hear
Na Africa we dey O make you hear Na Africa we dey O make you hear
Colomentality hear Colomentality! listen! Mr. Ransome you make you hear Na Africa we dey o make you hear this